Monday 14 September 2015

Monday Jokes: 32 Pidgin Proverbs

Laff it's off, ,,,,,,Pidgin Proverbs
1. Na for old age ashawo dey know the value of
pikin.
2. Woman wey never see problem... Na im dey still
hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later Γ© go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! Γ‰ No mean say fowl go lay boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.
10. Person wey don faint before no be stranger to
death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin
hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she
dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail
am!! Γ© go hail himself
15. Toto water small, but Γ© reach prick take baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE
GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, No matter
how ground strong, Them no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT
STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for
food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where owner
dey wait for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am
say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.
30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.
32. My thing and our thing no be the same oh.

No comments:

Post a Comment